[Lyrics] Brisco Oyiodudu - EndSARS (Full Lyrics)

By: / Oct 30, 2020

 

Brisco Oyiodudu - EndSARS (Full Lyrics)

Download Mp3 Here

Now nigeria no be country wey you feel say you go die for brother
Coz dem go kill you before you think of to die for
Country gone wrong, na money na em dem the fight for

 

After we vote you enter seat you change to python
My blood dey hot, this is my letter to the president

 

Bad government, dem the shoot anyhow with confidence
See the way dem kill nigerian youth for lekki toll gate
Mothers crying everyday because their children don late

 

Police the shoot you no the talk you buy dem bullet
Dem carry cutlass follow body na youth dem the machete
Everyday na burial rice people the buy from market
O my god i need to clear my head with black bullet

 

Na problem for this country dem say we the vote the wrong ones
No offense at times make we the vote the young ones
Because as you the old you know say your brain go the format
Old people no fit work for us dem no get format

 

O my god no be insult i the insult
That seat be like school we send you go there we need result
Now sars don the kill us, no body we fit to report
Nigeria be my wife i swear am heading for a divorce

 

Ah
End sars, end police brutality, end bad government
We are tired men, people dying everyday is not fair
Nigeria gone wrong, nigeria gone bad
End sars we want peace and unity
Yeah


    About Godwin Erenje 4292 Articles
    Erenje Godwin hails from Yala Local Government area of Cross River State, he's a Microbiologist, graduated from Benue State Polytechnic Ugbokolo department of Science Laboratory and technology. He's a graphic designer, an instrumentalist and a blogger, he's the founder and soul owner of Naijamp3 Website (www.naijamp3.com.ng & www.naijamp3tv.com.

    Be the first to comment

    Leave a Reply

    Your email address will not be published.